![*💡Loyalty Tested*Episode 4One night, Daniel dey sleep, Rex no dey sleep. E dey watch d window. Suddenly, Rex jump up, ba...](https://img3.voofla.com/242/642/568552682426427.jpg)
06/12/2024
*💡Loyalty Tested*
Episode 4
One night, Daniel dey sleep, Rex no dey sleep. E dey watch d window. Suddenly, Rex jump up, bark loud. Daniel wake up, shocked. Rex bark dey grow louder.
Daniel open d door, Rex rush out, e see one man try enter through d back gate. D man look shock as Rex rush come out, and Daniel shout, “Who you be?”
D man turn, wan run, but Rex block am. "Drop d bag," Daniel talk, holding d flashlight.
D man drop d bag. Daniel pick am up, na small tools wey d man steal from d shed. "Go!" Daniel shout.
The man run fast. Daniel close d door, Rex no move until d man run far. Daniel kneel down, stroke Rex, "You save me again. Thanks." Rex lick im hand, and Daniel realize sey Rex na im protector.